Tuesday, 17 November 2015

CHRISTMAS SHELE

CHRISTMAS SHELE
  I come online one day con see where person post sey Man Utd dey celebrate Christmas party. I con ask myself say, oh! This people don start their own Christmas from first week of November, not even December o... I reason the thing con see sey omo na because sey their economy good.
Nigeria! You go invite person come Christmas party for 1st week of November? The next thing you go hear nah "Hapu ya onweghi sense".
Our economy don bad to the extent sey Christmas don dey loose em shape. Na only few people dey celebrate Christmas wella now. Some people wey no hold money now sef don turn the thing to spiritual waka. You go dey hear things like" my church no dey celebrate Christmas", "dem no born am for December na October den born am".
Before! Before!! I remember wen I dey very small, by November you go don know sey Christmas don dey approach. Na banger you go dey hear everywhere, inside our house our aunty go enter market buy balloons come like this, put am for everywhere. Christmas light go dey on top many trees. People go dey ready to enter village for Christmas. That time on Christmas day na 2 big chicken dem dey kill but now if man see fish make em thank god. But our economy don die sote many people no wan tell their selves the real-real truth.
Now some people go dey sey " Omo me no dey celebrate Christmas , na SIN".
My brother na crime to push brosJ  betday from October go December?
25th na the surest  day to celebrate brosJ betday because e dey very economical and reasonable. My reason. Na sey;
1. You go do two celebration within the same period.
2. Na holiday period naturally.
3. By Calculation according to church, that period suit the history bookers.
So brotherly, leave that ya church thing, hassle, get money and celebrate Christmas oh!
I don start my own preparation from now, for Christmas. I don begin gather my garri, sugar, and groundnut o!
Chicken wey I bin dey train from January 1st just die yesterday nite because of cold. That one na small problem sha. No yawa we go talk more anytime #CFSTour enter ya fellowship.
The truth is bitter, but we don make am make e sweet.
@mcchimefrancis
@CFS_Tour.

No comments:

Post a Comment